NAPTIP and British High Commission Abuja don organise important event wey bring together Nigerian survivors wey bad people deceive, carry go Southeast Asia, and force dem to do online wayo.
Di event, wey dem call “Confronting the Global Scam Centre Crisis: Perspectives of Nigerian Survivors,” gather Nigerians wey dem recently bring back home — pipo wey criminals promise fake jobs and carry go Myanmar, Laos, Cambodia, and Thailand, where dem force dem to do online fraud under very harsh and dangerous konditions.
Di programme follow afta di successful rescue of 23 Nigerian survivors through di efforts of NAPTIP, Nigeria Ministry of Foreign Affairs, Nigerian Embassy for Bangkok, and British NGO EDEN — including operations for di Thai–Myanmar border and visits to Nigerians wey dem hold for Bangkok Immigration Detention Centre.
According to UN OHCHR 2026 report wey dem call “A Wicked Problem,” at least 120,000 pipo dey currently dey held for forced scam operations inside Myanmar alone, while di total don reach ova 300,000 across Southeast Asia. Survivors come from at least 66 kontries, and between 2020 and 2025, 74% of known victims dem carry go Southeast Asia afta dem promise dem better-paying jobs.
Di UK Deputy High Commissioner Gill Lever OBE say di UK dey stand with Nigeria to fight dis krime.
Behind every scam is a human story.
Today, Nigerian survivors shared their experiences of trafficking, coercion, and resilience.The UK and @naptipnigeria remain committed to confronting the global scam centre crisis and supporting survivors.
#EndHumanTrafficking pic.twitter.com/POe7Cw41p5
— UK in Nigeria🇬🇧🇳🇬 (@UKinNigeria) February 23, 2026
Di NAPTIP Director of Public Enlightenment, Mrs. Kehinde Akomolafe, praise di survivors’ courage and promise say di agency go keep protecting Nigerian citizens.
As Director General of NAPTIP, I reaffirm that survivors are not criminals. They are victims of organized exploitation networks that operate across borders, exploiting digital platforms and weak migration systems. The DG NAPTIP stated this at the survivors’ engagement on
1/2 pic.twitter.com/hjviSSAOEZ— NAPTIP (@naptipnigeria) February 23, 2026
One survivor tok say: “Dem promise me good job and better life. Instead, dem trap me and force me to do tins wey go against evritin wey I believe, while I dey live in constant fear. I dey share my story so dat oda Nigerians go fit recognise di warning signs and protect demselves.“
Authorities warn pipo say any legitimate employer no go dey recruit through WhatsApp, Telegram or Facebook. Any overseas job wey only need tourist visa na scam — do not go!
