Presidents Paul Kagame, Félix Tshisekedi and Donald Trump
President Felix Tshisekedi wey dey rule DR Congo and Rwandan leader Paul Kagame don sign agreement for peace and money matter for Washington DC, wey be capital of United States of America
Na American President Donald Trump arrange am for one new place dem call ‘Donald J Trump Institute of Peace.
Trump salut di agreement – say e go help end years of wahala and long-time gbege for di region,
Hi tok say di new plan go bring permanent ceasefire, make rebel groups drop dia weapons, help refugees return house, and bring economic prosperity plan.
“I get plenty confidence for both leaders.We go keep our commitments. I sabi say dem too go keep dia own, follow di agreement well-well, and build better future for di people of dia countries.”
Trump tok say di peace ceremony na “great day” for Africa and for di whole world, and later dem call am “historic.”
Di United States president say e go sign bilateral agreements with DR Congo and Rwanda on rare-earth mining.
E still add say big U.S. companies go enter di region, and “everybody go make plenty money.”
Satisfaction
Congolese President Tshisekedi talk say na one big ‘turning point’ for Africa.
E tok say DR Congo don tu sofa for years because of war.
“I believe say today na di beginning of new road — e hard, e get wahala, yes, but na road wey peace no go just be wish or aspiration again, but na real turning point.”
Rwandan leader Paul Kagame tok say efribodi dey expect beta outcome.
“Nobody bin dey ask President Trump make e carry this work. Our region no dey headline much, but when di president see say e fit help bring peace, e sharply grab di chance. E sharply grab am, ”Kagame tok.
People wey sabi dis mata don dey reason say di peace deal go match U.S. economic interests, as Washington bin dey use political pressure to bring di presidents of Kinshasa and Kigali together — somtin wey African regional mediation no fit achieve.
Doubt and hope
Di agreement build on one earlier peace framework wey dem reach some months back, wey commit both countries to respect territorial boundaries, stop any form of aggression, and no support armed groups again.
But regional analysts dey tok say e still no clear weda dis agreement fit truly end di decades-long conflict.
Dem add say wetin even pass di deal na di Doha talks, wey include representatives of di Rwanda-backed M23 militia — di same group wey earlier dis year capture Goma and Bukavu for Kivu region and set up their own administration for di areas wey dem control.